Nigeria on my mind.
Nigerians wether una like it or not Tinubu is the Messiah God don give una to turn around this country for this time wey we dey so, but una no wan gree, una dey do strong head.
Give the man chance, una no gree. Una dey talk say him be a thief.
Una carry him go ICPC. ICPC say he no be thief. Abi na lie? This was even when he was in opposition fa!
Nigerians, why una be like this?
This man wey God don give una so, wey una no want accept na him make Lagos they shine as una they see am today. Abi na lie? That one never reach do una as evidence say the man fit to perform well well for Nigeria case too?
The man get plenty experience of performing well well everywhere wey him dey before. No be true I talk?
All the thins wey person wey fit to rule this country well well need na him Tinubu get. Abi I talk lie? Oya, make we look am together.
He get:
- – guts, lots of it
- – he get intelligence well well
- – he be a management guru
- – he be account and economy expert
- – he be political strategist per excellence
- – the man na strong man well well
- – he get good health
- – he get wisdom
- – he get compassion
- – he sabi how to identify people wey fit deliver well well whether Ibo, Hausa or Yoruba and appoint them to positions
- – he sabi budgeting well well
- – he no dey for tribalism
- – he no dey do nepotism
- – he believe well well for Federalism
Which one remain? Abi wetin una dey find?
Me, I don talk my own o, if una no let the man rule, na una sabi o. Sikena!
By RT Banjo
Read also:Tinubu mourns prominent corporate lawyer, Chris Ogunbanjo